For those of una wey say our combatant no rescue anything unto say no be the first time wey dem go talk so be dat, oya make una see the pictures of the shenkes dem wey our awua dem rescue from boko boys kaban inside sambisa.
Friday, 1 May 2015
Wednesday, 29 April 2015
OVER 200 SHENKES NA IM ARMY DON RESCUE
The nigerian army on tuesday don polongo say dia combatant enta sambisa go scatter the place, no be only say dem murd boko boys oo, dem yarn say more dan 200 yarinya and amaria na im dem rescue from them boko camp. Aproko people don dey yarn say e fit be say the chibok girls dey among d shenkes wey dem rescue but senior men for defence headquaters say dem not fit talk put for that level now unto say the dem d shenkes still dey undergo check and balance make dem for know dia paro wella.
One thing wey i don dey talk since and wey i go still dey tallk untill all this finish be say, boko boys no reach, my rugged go serrie leon, peace reign, dem forward enta liberia, war lord sherif and d golf forces belive say moses no be calabar man, e no still do, we enta bakassi, gaskia, things change, sudan nkor, haba mallam, mali dey dia ooo, kai, my friend!! boko no reach.
I believe in d rifle creed, datz how we roll in the armed forces. Train hard, so we fight easy
One thing wey i don dey talk since and wey i go still dey tallk untill all this finish be say, boko boys no reach, my rugged go serrie leon, peace reign, dem forward enta liberia, war lord sherif and d golf forces belive say moses no be calabar man, e no still do, we enta bakassi, gaskia, things change, sudan nkor, haba mallam, mali dey dia ooo, kai, my friend!! boko no reach.
I believe in d rifle creed, datz how we roll in the armed forces. Train hard, so we fight easy
BARZ SWEET, NA MURD SPOIL AM
If na so e be true true, my guy if you still dey barz, time don reach make you reason am ooo. I know say if man blaze, e go dey see far, but na now i know say as you dey see far, na so your murd dey near, Elders say, a wise is enough for the word. by d time your kidney be like roasted corn, your brain go light up.
Tuesday, 28 April 2015
E GO SOON RED FOR UNA
The new GCFR wey dey touch line dey warn up to collect paro for bros J hand don yarn say, una see dis things wey dey call dia self boko, say na mai-mai. General say na play dem dey play oo, say once he show, him go make dem know the difference between i was there and i shall be there. The General yarn say dem be gbab and once him show, him go treat dia F***-up the way dem dey treat gbab own. He provoke say which one be make dem dey murd- murd small smal yaro and yarinya up and down. but he say make dem no worry say day go soon break meet dem.
Monday, 27 April 2015
IF U WAN DEY FLY, GO BUY PASS OO
NAF 2015 don show ooo, for una wey una think say to fly na to blow hand fan, form to join Nigerian Airforce don show ooo, make una go buy and fill the life package for careers.nigerianairforce.gov.ng .God bless Nigerian Armed Forces.
U DON HEAR?
shey u sabi say u no fit buy sumtin from e-bay with naija IP address? but dat na old yarns now. shey u still sabi say e get as u fit take dey watch all dis whity films dem from naija without dstv even go reach match wey dstv no get liver to cover, d main thing be say paro don dey wey go make US and UK severs believe say na dis end u dey, but bros, u no go pass airport. all u need na to drop small bar, make u take purchase teleport service from tizeti. dem go dash you router follow oo and u fit dey gbadun all ur paro from naija here. u dey feel am? for more yarns about the level, chech here www.wifi.com.ng/teleport
I DON SHOW
My people, make una no vex say i gbef for long time now. as una know, man must wack. na make e for no loss na im man pikin dey find. but like dis like dis, levels suppose gel. all join sha, any which way, make una dey expect koret security news from dis ayunda.
Subscribe to:
Posts (Atom)




.jpg)



