Monday, 4 August 2014

MY PIKIN NO BE TERRORIST OO, WHO TALK SO?


Attin una remember dat guy wey soldiers gbab for kaduna unto say he fit dey one of those wey arrange heavy banger to murd oga buhari, toh! Him mama don comot ooo, and d maleh dey raise voice say her pikin no be terrorist fah! As e be now, who dey blow lie and who dey talk true? We never know. But why the bros J sef go dress like yanrinyan dey run colour parade for area wey bomb dey blow like banger,like say christmas don near. all join sha. na him sabi.

Friday, 1 August 2014

BROS V.E.C DON BEG OOOO


Senior barry boy vector don arrange abeg make una no vex leta give him before ogas dem for YSG entertainment. Una go remember say the last twelve months no go well with bros after gbege burst between him and him record label. But like this like this, V.E.C  don show say him na senior man for real as e don arrange make una no vex leta give dem. Barry boy go say na coperation cause am wey rice for get chance full pot.

DEPOT GATE DON OPEN OOOO, BOKO, UNA BEANS DON BURN. NA ARMY RECRUITS TALK SO.


Na today the transformation go start for some bloody civillians wey don decide to serve their papa land. Tata don start fall in nigerian army depot zaria, kaduna state, recruits morale high, drill instructors mind dey sweet as food don come.  According to news, entry and bapatism go shele today then documentation go follow. Incase una no know, one heavy sign dey depot gate wey say “NO GOING BACK” na only two things dey involved, pass out after six months or murd for dia. But one thing weysure be say after six months, boko haram beans go burn their garri go soak as boys wey don become men go wan test their rifles weda ed dey jab wella abi na moi-moi. Make una stay tuned for tori on wetin dey shele for dat zone.