Attin una remember dat guy wey soldiers gbab for kaduna unto
say he fit dey one of those wey arrange heavy banger to murd oga buhari, toh!
Him mama don comot ooo, and d maleh dey raise voice say her pikin no be
terrorist fah! As e be now, who dey blow lie and who dey talk true? We never
know. But why the bros J sef go dress like yanrinyan dey run colour parade for
area wey bomb dey blow like banger,like say christmas don near. all join sha. na him sabi.
Monday, 4 August 2014
Friday, 1 August 2014
BROS V.E.C DON BEG OOOO
Senior barry boy vector don arrange abeg make una no vex
leta give him before ogas dem for YSG entertainment. Una go remember say the
last twelve months no go well with bros after gbege burst between him and him
record label. But like this like this, V.E.C
don show say him na senior man for real as e don arrange make una no vex
leta give dem. Barry boy go say na coperation cause am wey rice for get chance
full pot.
DEPOT GATE DON OPEN OOOO, BOKO, UNA BEANS DON BURN. NA ARMY RECRUITS TALK SO.
Na today the transformation go
start for some bloody civillians wey don decide to serve their papa land. Tata don
start fall in nigerian army depot zaria, kaduna state, recruits morale high,
drill instructors mind dey sweet as food don come. According to news, entry and bapatism go
shele today then documentation go follow. Incase una no know, one heavy sign
dey depot gate wey say “NO GOING BACK” na only two things dey involved, pass
out after six months or murd for dia. But one thing weysure be say after six
months, boko haram beans go burn their garri go soak as boys wey don become men
go wan test their rifles weda ed dey jab wella abi na moi-moi. Make una stay
tuned for tori on wetin dey shele for dat zone.Thursday, 31 July 2014
SHU....! RECRUITS DEY RAISE GBEGE AGAINST COMMANDER.
No be small tin for 35AB Alamala barrack Abeokuta on 26th
July 2014 ooO, wey small small boys wey never even collect uniform kum go
gather for the cantonment gate say dem ready to yagayaga the commander sake of
say the whole recruitment process na magomago confirm. But as per say oga na
sure guy, him treat dem jeje. At all at all na im bad pass, dat wan no say
makee dem no pay for the yawa wey dem cause. Sergeant korofo treat their
fuck-up pieces. Make una expect more tori unto this package.
EXCLUSIVE ARMED FORCES NEWS IN PIDGIN
Welcome to my world, enjoy exclusive inside story of the
Nigerian armed forces in pidgin right here. This is my first publication,
subsequent publications will come in pidgin english. Being the first of it’s
kind, the idea is to make civillians aware of the happenings in military
formations all over the country and to make it enjoyable and fun filled.
EXCLUSIVE ARMED FORCES NEWS IN PIDGIN
Welcome to my world, enjoy exclusive inside story of the
Nigerian armed forces in pidgin right here. This is my first publication,
subsequent publications will come in pidgin english. Being the first of it’s
kind, the idea is to make civillians aware of the happenings in military
formations all over the country and to make it enjoyable and fun filled.
Subscribe to:
Posts (Atom)
