The nigerian army on tuesday don polongo say dia combatant enta sambisa go scatter the place, no be only say dem murd boko boys oo, dem yarn say more dan 200 yarinya and amaria na im dem rescue from them boko camp. Aproko people don dey yarn say e fit be say the chibok girls dey among d shenkes wey dem rescue but senior men for defence headquaters say dem not fit talk put for that level now unto say the dem d shenkes still dey undergo check and balance make dem for know dia paro wella.
One thing wey i don dey talk since and wey i go still dey tallk untill all this finish be say, boko boys no reach, my rugged go serrie leon, peace reign, dem forward enta liberia, war lord sherif and d golf forces belive say moses no be calabar man, e no still do, we enta bakassi, gaskia, things change, sudan nkor, haba mallam, mali dey dia ooo, kai, my friend!! boko no reach.
I believe in d rifle creed, datz how we roll in the armed forces. Train hard, so we fight easy